HopefulMe

Hopeful Me

Message • Aug 8, 2020

School no be scam o

School Projects
Today na Saturday.

As you dey arrange your house, still carry today plan, arrange your life join.

Find skill or handwork wey you fit learn. The ones wey you sabi already, tek am serious ni.



Las las Las, School no be scam.

School fit help you do some kin work, school fit help you go some kin place. But if you go school finish u no come get money, na dia wahala dey o.



But reason am,

E get pipo wey go school wey no mek am. E get ppl wey no go school wey still no mek am.

Success in dis life na individual sometin plus God's grace.

If you dey go school now, and you know sey u no get tangible vision, no reason to drop out.

Even Bill Gates wey bin drop out get certificate now.



I go like hear wetin you wan yan about this mata.

Na ur boy, Johnson Crystal Kalu. Carry this message come for your domot.

Una Good morning o.



#HopefulMe_Pidgin #Quote #Pidgin #HopefulMe #SchoolNoBeScam #School #Certificate
1.3K Views
HopefulMe community

Hello there!

Stay close to the hope we share

Join the community to respond, encourage others, and keep uplifting conversations going.

Post Comment 0

Be the first to share your thoughts.

You might also like

Stay Inspired

Life isn't boring, inspire the world around you!