7th October, 2020 | 702 Views | 0 Comments
WE GO DEY ALRIGHT
Category: MotivationLabel: Obasi Grace
Even if say,you dey claim indaboski bahose,iron medal or even celeb for social media and among your crew of cartels,most of us know wotsup and say nah cruise be that,nah pain you dey try cover up so,make e no be like say nah your matter kukuma worst nii but you sha need to be calming down o.
I know say,plenty of us dey even form wetin we no be,make e be say people just hail and twuale for us, e don dey too much sef,we dey even borrow stuff wey we no get dey cruise life join.
E red everywhere but we no go come over-do unto say;everywhere red,come dey leave life wey we no suppose live, borrow stuff wey we no get,dey leave another person life,carry our own throw-way far far,join bad gang(cultist),soak our hand for blood and start to do things wey no pure sha sha..
Nah person wey calm down,understand this life jeje,wey no over rush but jejely the do pure hustling wey go live,enjoy the money o,make we sha no forget say,nah the patient dog,the eat the fastest bone kwa.
Everything go dey alright,we no need to loose guard,we no need to fold our hand dey put blame for the jajaweeds wey dey our caban called naija,we all need to hustle well,find our own passion,dey serious for am and no give up sha sha.
Make we stop to dey form wetin we no be,nah the same shit everybody dey so,legit hustling be dey key o and las las everthing go dey alright.
https://www.ahopefulme.com/blog/333-WE-GO-DEY-ALRIGHT
Obasi Grace
Motivational Speaker at Hopeful Me
Abakalilki, NigeriaYou can get enough of everything you want in life, if you can truly help other's get what they want.... Be a reason why someone will smile and not give up in life!
- My favorite Quote
Related Articles
Fear episode 3
By Evansmac | 856 views