7th October, 2020 | 966 Views | 0 Comments
THE STRUGGLE
Category: MotivationLabel: King_Esoteric
THE STRUGGLE
Man dey work but nothing come out, man go sweat but e be like waste. E come be like say ur village people tie wrapper for ur matter.
This life!!!!!!
Make I reason you something, see eh:
Things go hard like shit wen no wan comot from nyash, you fit fall e go come be like say na normal thing, u go shout, cry dey complain but u must understand say na part of the whole process. You must to continue to push like say na there everything end. Na normal levels say wetin u plan no be so e come out but no shaking, na so this life be, sometimes as u take reason something no be so e go be. Carry ur hustle for head like gala, no let any mugu tell u say nothing come out. See, u fit be the best no reason am, dey push like woman wen dey labor room. Mistakes go choke along the way eh but u go use am take learn one or two things. Last last u go burst all man brain.
Remember say d only thing man no fit achieve na wetin him no put him mind.
Na you get the TOP.
#STAY STRONG.
-Esoteric
https://www.ahopefulme.com/blog/331-THE-STRUGGLE
Onwumere Godwin Chinemerem
Writer at Hopeful Me
Lagos, NigeriaWe M O V E
- My favorite Quote
Related Articles
#NoToSucide
By Benjamin Bright | 1010 views